fbpx
June 17, 2024

Nasarawa bomb explosion: “40 pipo don kpai” – Governor Sule

nasarawa-bomb-explosion-40-pipo-don-kpai-governor-sule-annouce-di-death-of-40-pipo

Governor Abdullahi Sule of Nasarawa State don yarn ay di death toll from Wednesday bomb explosion for di State don rise from 27 to 40.

Di bomb explosion happen for Rukubi, di village wey dey di border between Nasarawa and Benue States.

Also, as Governor Sule dey brief newsmen on Thursday, hin yarn say dem count approximately 40 pipo wey kpai.

Additionally, hin explain say di rumour wey bin dey go round earlier bin yarn say na airforce carry out di bombing. After hin tok that one, hin open up say no single airforce plane bin fly above that area.

FOR MORE NEWS: killing of Joint Security members: Residents don run comot for Niger community

Di governor yarn say no be airforce olay fly, but na drone dem see wey fly above di area kon drop di bomb.

Following di Nasarawa bomb explosion, Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria bin don tok before say na military jet cause di explosion.

Lawal Dano of di Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria, on Wednesday, follow yarn say na only di military get jets to do that kain thing.

Also, dem call on di government so that dem go do proper investigation on di incident.

You fit go read di full tori…READ MORE