fbpx
May 18, 2024

killing of Joint Security members: Residents don run comot for Niger community

killing-of-Joint-security-members-in-Niger-community-makes-resident-run-for-their-lives

Residents of Galkogo, Shiroro Local Government Area of Niger State don run comot from dia community following di allege killing of some number of Joint Security Taskforce and local vigilante members during airstrike by an unidentified jet fighter.

E dey gathered say di incident happen on Tuesday afternoon when di fighter jet mistake di men of di State security team as bandits. Na so dem open fire on dem.

Residents of Kalgoko community wey dey confused yarn say dem neva experience any presence or threat of bandits for dia community wey go warrant di shelling.

According to report, two Hilux vans carry di body of di security personnel wey don kpai go Minna, di State capital at about 4:00pm. Dia remains dey deposited for di IBB Specialist Hospital.

Another report yarn say di leader of di taskforce wey sustain injuries dey receive medical attention for one unknown medical facility for Minna.

Di development of di killing of Joint Security member for Niger community don force di security taskforce comot for di community. This matter don put fear for di minds of all di residents of di village and environs. Dem sef don pack dia load run comot because of  fear of attacks from bandits.

However, all di efforts to get confirmation about di killing of Joint Security member and di incident from di State Commissioner for Internal Security and Humanitarian Services, Hon Emmanuel and di State Police through di Police Public Relations Officer, PPRO, DSP Wasiu Abiodun don fail.

You fit go read di full tori…READ MORE