fbpx
May 19, 2024

Partner Tinubu for national development – APC tell NASS

APC-ask-nass-to-collaborate-with-government

Di National chairman of di ruling All Progressives Congress, APC, Senator Abdullahi Adamu don ask members of di National Assembly, NASS to collaborate with di executive arm of government for peace and national development.

As hin dey receive some senators led by di Senate President Godswill Akpabio, on Sallah homage to hin residence for Keffi, Nasarawa State for di weekend, Adamu yarn say Nigerians expect better dividends of democracy under di present administration through harmonious relationship between di legislative and di executive arms of government.

 

FOR MORE NEWS: Nigerians dey suffer, 30 pipo dey call me everyday dey find help – Daniel Bwala

 

Di chairman, wey congratulate Akpabio and hin deputy, Senator Jibrin Barau over dia emergence as di new presiding officers of di Red Chamber, advise dem say make dem settle down for good governance of di Kontri with genuine feeling since di period of contest for offices done pass.

Earlier, di Senate President express happiness for di opportunity wey hin get to pay homage to di APC national chairman, and hin add say “Sallah na period to exchange love and na wetin Islam tell dem to do.”

Also, hin describe di party chairman as a man of integrity wey pilot di recent zoning arrangements for di National Assembly wey produce results.

You fit go read di tori see as APC ask NASS to collaborate with executive arm of government…READ MORE