fbpx
May 11, 2024

“Don’t be deceived, marriage still dey work” – OAP Nedu

nedu-yarn-say-working-marriages-still-exist

Popular media personality Chinedu Ani Emmanuel, better known as Nedu, don confirm say working marriages still exist despite di increase divorce rates.

Nedu, wey recently unveil hin new lover months after hin first marriage crash during recent episode of hin Honest Bunch podcast, express belief for di institution of marriage.

Hin encourage singles make dem no dey influenced by negative news surrounding marriages. Dis advice come after reality TV star Teddy A, wey be guest on di show, share di story of hin own love journey with hin wife, Bam Bam.

Nedu yarn say social media dey always tok negativity, particularly regarding marriage. He yarn say those with happy marriages dey always keep dia marriage private to avoid judgment, as external opinions fit harm relationship.

 

FOR MORE NEWS: Priscilla Ojo don explain rumours about her relationship with Enioluwa

 

E neva too tey wey Big Brother Naija star and singer, Tope Adenibuyan, popularly known as Teddy A, narrate di state of hin relationship with hin wife, Bambam and di event wey lead to hin wedding proposal.

Teddy reveal say him and Bambam dey in serious fight for about two weeks before hin propose.

You fit go read di tori see wetin Nedu tok as hin yarn say working marriages exist…READ MORE