fbpx
December 22, 2024

‘Fear every girl for choir’ – Nedu Wazobia

nedu-wazobia-choir-character

Famous On Air Personality, Chinedu Ani Emmanuel, wey dey popularly known as Nedu Wazobia, don tok say di outward appearance of girls wey dey choir no dey always match their true character.

Nedu tok dis tori during chat on top Naija FM’s ‘Across di Bridge’ show.

As hin dey narrate hin personal experience with choir member wey hin believe say be virgin, Nedu argue say di girls for choir  sometimes no be godly girls.

Nedu narrate hin experience and how hin friend discourage am from engaging di girl based on her ungodly activities during night rehearsals for church.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don call for Military collaboration for Africa

 

Nedu yarn say hin bin wan engage di girl. But di friend as am say why hin wan engage her?

As hin narrate di tori finish, hin tok say person need to fear every girl wey dey choir. But some dey  very, very wonderful.”

When asked by one of the hosts if it is only sisters that are to be feared, he answered, “brothers are the worst.”

You fit go read di tori as Nedu Wazobia drop gist on choir character…READ MORE