fbpx
December 23, 2024

Netflix don extend crackdown on password sharing to more countries

netflix-extend-crack-down-on-password-sharing-to-more-countries

Netflix dey introduce limits on password sharing for four more countries: Canada, New Zealand, Portugal and Spain.

Following this development, dem ask Customers for those countries make dem pay extra fee if dem want make friends and family share dia subscription. This na for di friends and family wey no dey live with them.

This move follow di crackdown on password sharing for South America.

Also, di estimate of di media giant show say 100 million people around di world dey use shared accounts.

Although, na like that users dey use dia netflix account. However, as di matter be now, di shared accounts dey affect Netflix ability to invest in new programming content. According to di firm, dem dey plan to extend di new approach to more countries in coming months.

FOR MORE NEWS: Ini Edo don make her international debut with di production Shanty Town movie for Netflix.

In addition, inside blog post wey dem publish on Wednesday, di firm yarn say over di last year, dem dey exploit different approaches to address this issue for Latin America. And now,  dem ready to roll them out more broadly for di coming months, starting today for Canada, New Zealand, Portugal and Spain.

Up until now, e dey easy for subscribers to share dia login and password with friends outside dia home.

Back in 2017 Netflix bin even approve di practice when dem tweeted “Love is sharing a password”.

But growing competition for di streaming market, and customers wey don cut back on subscriptions due to di rising cost of living, don make Netflix focus on closing up that revenues of password sharing for more countries.

You fit go read di full tori…READ MORE