fbpx
May 19, 2024

Ini Edo don make her international debut with di production Shanty Town movie for Netflix.

ini-edo-no-be-feminist

Award-winning Nollywood actor, Ini Edo don score another hit for her career line. Ini Edo make her international debut with di production of di Shanty Town movie for Netflix.

Ini career don reach almost two decades of acting. Now she don dey make strong inroads in production for global level as she co-produced di dramatic crime thriller.

Shanty Town na tori wey surrounds three unusual prostitutes.  Dem unite to take down one of di biggest criminal rings for Lagos state.

FOR MORE NEWS: Bobrisky anounce hin liposuction surgery plan for social media

For di project, Ini Edo double as a lead character, where she play di nrole of Ese wey mean  ‘The Fire Brand’.

Di tori no be only about collaboration to fight crime, but na that of freedom for all women to become wetin dem wan be and live their positive dreams. This tori na great advocacy for women and young girls wey don  go through a lot.

You fit remember say e don tey wey Ini Edo be passionate campaigner for women inclusion for politics, tech, and every worthwhile aspect of human development. This na because e go prove say women be force to reckon with.

With Shanty Town, Ini Edo make her international debut. She join di league of top influential Nigerian and African women for di film production circle which include Mo Abudu, Funke Akindele, Bolanle Austin-Peters amongst others.

You fit go read di full tori…READ MORE