fbpx
September 30, 2024

New naira: Banks go ensure workers’ safety – CIBN

new-naira-banks-cibn

Di Chartered Institute of Bankers of Nigeria CIBN on Friday yarn say dem dey plan with di Body of Banks’ Chief Executive Officers to address di current New naira challenges wey di redesign of the N1,000, N500, and N200 notes dey bring.

To make di situation easy, dem go allow banks continue to remain open to serve di public as long as e dey safe to do so.

However, he tok say di safety of bank workers dey important.

FOR MORE NEWS: 150 Women Go Benefit From MTN N300m Equipment Grant

Several deposit money banks don come under attack by angry customers, with protests wey dem don record for different states across di country over di scarcity of di redesigned N1,000, N500, and N200 notes.

Di President, Major General Muhammadu Buhari (retd.) on Thursday yarn say di old N200 note go continue to be  legal tender till April 10, 2023, while hin advise Nigerians make dem deposit dia old N500 and 1000 notes with di Central Bank of Nigeria.

However, di CIBN, for inside statement signed by di President/Chairman of Council, Ken Opara, yarn say di management of banks dey empowered to take proactive measures to close operations for locations where dem dey experience security challenge and dem fit inform di CBN, dem no fit endanger dia workers because of new naira notes.

You fit go read di full tori…READ MORE