fbpx
May 17, 2024

Ex-finance minister dey blame CBN for new naira crisis

ex-finance-blame-cbn-crisis

A former Minister of Finance, Dr Idika Kalu, don blame di logistics of di Central Bank of Nigeria CBN for di crisis with di distribution of new N1000, N500 and N200.

Speaking on Channels Television on Friday, he yarn say di new naira scarcity dey as a result of a huge logistic mistake.

He yarn say e dey clear say we dey deal with huge logistic mistakes wey don happen.

Kalu add say di CBN suppose don do assessment from di beginning of how long and wetin e go take to ensure di efficient distribution of di new notes.

He explain say di reason why di new notes no dey for banks when people need am na because of poor logistics.

FOR MORE NEWS: New naira: Banks go ensure workers’ safety – CIBN

Also, di Ex-finance blame CBN reasons for di old notes redesign wey don cause crisis. Hin add say countries no dey change dia currencies because dey wan improve di effectiveness of monetary policies.

In addition, he say e get other ways and other policies wey di CBN and di Federal Government for introduced if dey wan tackle corruption and di high amount of currency in circulation.

Kalu still add say di naira redesign plan of the CBN fit likely lead to contraction in di economy.

Also, hin describe di naira redesign policy of di CBN as draconian, and  something dey wrong with wetin di CBN dey try do.

You fit go read di full tori…READ MORE