fbpx
April 26, 2024

Ngige work for any presidential candidate – Ngige

Di Minister of Labour and Employment, Dr Chris Ngige, don come out tok say hin no dey readi to work for di emergence of any of di presidential candidate, for di coming election.

Ngige who be member of the All Progressives Congress, APC, yarn say all di four presidential candidates wey bin dey di frontline, all of dem na friend dem be to ram friends, so him no go campaign for or against any of dem.

U FIT ALSO READ

Di Minister yarn dis one on Wednesday, while speaking to journalist.

Hin tok say hin want Nigerians to look at di programmes of di candidates and determine which one dey more preferable dan di other, and make sure say dem vote right.

When dey ask di minister say which of di candidate hin think say he go win di election, Ngige tok say hin no fit predict, so make Nigerians choose who dey want to be dia president by demself.

When dey ask Ngige hin personal relationship with each of di frontline presidential candidates, Ngige tok say: “ both Malam Kwankwaso, Alhaji Atiku Abubakar,Peter Obi, Bola Ahmed Tinubu, dey are all my friends

To read di full tori CLICKHERE