fbpx
May 19, 2024

85 per cent of Nigerian doctors dey plan to comot for di country

8689-285-per-cent-of-nigerian-doctors-wan-travel-out

At least 85 per cent of Nigerian doctors dey plan to comot for di country to find greener pastures.

Na from di Nigerian Association of Resident Doctors this information come from.

Report follow tok di countries wey immigrants prefer to go na di United Kingdom and di United States of America.

According to wetin di President of di association tok, Dr Emeka, hin yarn say if di government no do anything to address that matter wey dey cause brain drain for di country, di situation go worse for di health sector.

FOR MORE NEWS: Nigerian pharmacist share sad story of colleague wey kpai because of power outage

If pipo see better opportunities for other countries like that, dem no go waste time go there.

Dr Emeka mention say as of October 2022, na only 10,000 resident doctors dey di country.

Hin tok say if anything wan happen, e suppose be increment for di immigration. This na because nothing don change in terms of di working condition, infrastructure, and security.

85 per cent of Nigerian doctors dey plan to travel out because of di brain drain and knowledge gap in human capital.

Di 2023 macroeconomic outlook report wey Nigerian Economic Summit Group release, yarn say said aside from di health infrastructural gap, Nigeria don lose plenty medical professionals to brain drain, for di health sector.

You fit go read di full tori…READ MORE