fbpx
May 4, 2024

Apologise for working against Tinubu, Osun APC – Akere to Aregbesola

Aregbesola-collect-advise-to-apologise

Di former Minister of Interior, Rauf Aregbesola, don collect advise to apologise for allegedly working against President Bola Tinubu and di All Progressives Congress (APC).

Na di former Commissioner for Information and Strategy wey serve for Aregbesola first term as governor of Osun State, Sunday Akere na hin give di advise, on Monday for Osogbo.

Also, di Osun APC chieftain bin dey tok in reaction to statements credited to Aregbesola on Sunday. E tok am for reception wey dey organised by di concerned Muslim scholars and clerics for di South-West of Nigeria forOyo town, Oyo State.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don appoint Hannatu Musawa as Special Adviser on Entertainment, Culture

 

Also, for di reception, Aregbesola yarn say hin owe hin achievements and success in politics to President Bola Tinubu and former President Muhammadu Buhari.

However, Akere claim say Aregbesola bin work against di interest of di APC during di February 25 presidential election and di July 16, 2022, gubernatorial election for Osun State.

Di Peoples Democratic Party for Osun State don roundly defeat di APC for both elections for di state.

And, hin advice Aregbesola make he apologise for hin alleged anti-party activities.

In addition, hin tok say after di apology, make him and hin supporters appear before Prof. Isaac Adewole committee instituted to reposition APC for di state.

Reacting, Lani Baderinwa, wey serve for Aregbesola second term as Information Commissioner, dismiss di allegations of anti-party actities against hin  former principal.

You fit go read di tori as Aregbesola collect advise to apologise…READ MORE