fbpx
May 15, 2024

N8,000 palliatives na insult to poor Nigerians – Kenneth Okonkwo

okonkwo-describe-fg-plan-as-insult

Mr Kenneth Okonkwo of di Labour Party, LP, don describe di Federal Government, FG plan to pay poor Nigerian households N8,000 monthly “as an insult to common sense and means to steal government fund in di name of poor Nigerians.

Inside post via hin Twitter handle on Monday, Okonkwo claim say di ruling All Progressives Congress, APC, government dey arrest and detain Nigerians without trial, hin tok say na anti-people.

You go remember say Federal Government bin announce plan to pay N8,000 monthly to 12 million poor Nigerians as palliatives to cushion di effect of fuel subsidy removal.

 

FOR MORE NEWS: Yul Edochie dey thank God for peace, Judy Austin amid divorce from first wife, May Edochie

 

However, di veteran Nollywood actor claim say di amount no go reach poor Nigerians wey fit barely afford plate of food.

For inside hin post, hin write sat di government start dia regime with N352 increase in fuel per litre, dem depreciate naira by 82% from di first day in office, borrow $800m (N650b) to share N35b to Judiciary, N70b to di Legislature, then N48,000.00 for a family of about six persons for six months.

Also, hin ask say wetin Nigerians wan do with N8,000 per month, especially household of about 6 persons per month. In addition, hin tok say dis government na waste and we dey see di true definition of cluelessness.

You fit go read di tori as Okonkwo describe FG plan as insult…READ MORE