fbpx
May 18, 2024

Oluwo to Tinubu: No coup must survive under your watch

oluwo-of-iwo-task-tinubu

Di Oluwo of Iwo, Oba Abdurosheed Akanbi, yesterday, task President Bola Tinubu say make hin rally Military forces for Africa to stop di coup against President Mohamed Bazoumin of di Niger Republic, and also to strengthen democracy for Africa.

As di tori be so, di monarch, inside statement by hin media aide, Alli Ibraheem, encourage di President make hin use hin position as ECOWAS Chairman to stop di coup for di Kontri and return am to democracy.

Hin tell Tinubu say no Coup must survive under hin watch as ECOWAS chairman. External authorities and forces need to dey mobilized to grow African democracy and ensure sanity.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don approve new salary structure for health workers

 

In addition, hin yarn say to defending democracy na primary task of ECOWAS authority. Also, hin tok say hin dey convinced say Tinubu go lead di body constructively by fortifying di system in favour of democracy. Democracy go survive for Africa.

Also, hin tok say President Tinubu need to harmonize forces to win di war against democracy. And, hin must show strength and prove himself beyond expectation for hin new office as ECOWAS boss.

You fit go read di tori see as Oluwo of Iwo task Tinubu…READ MORE