fbpx
May 6, 2024

Container-laden Truck Don Fall On Top Commercial Bus For Lagos, 9 Pipo Don Kpai

container-truck-don-cause-di-death-of-pipo-wey-enter-commercial-bus

Less than one month after container-laden truck kill one person for di Apapa-Oshodi expressway, another fully loaded 20ft container wey comot for Apapa port warehouse, don fall on top commercial bus (Danfo) and e cause death of nine pipo for Ojuelegba Bus-Stop for Lagos on Sunday.

For inside press statement by di permanent secretary, Lagos State Emergency Management Agency ( LASEMA), Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, he yarn say na one person dem rescued alive.

According to am, di commercial bus bin dey pick passengers when di container truck lose control fall on top of di commercial bus, and e cause di death of six adult and two children.

FOR MORE NEWS: 11 pipo Burn To Death For Ondo Auto Crash

Oke-Osanyintolu yarn say as hin reach di scene, one truck wey carry 20ft container na hin dem see wey don land on top of another commercial bus. Further investigations reveal say di bus bin dey pick up passengers when di truck lose control fall over di side of di bridge.

In addition, hin tok say after dem suspend di container load with di help of di Agency forklift, dem cut di top of di bus with light rescue equipment. Also, dem don take one single adult woman wey dem release alive go trauma centre.

You fit go read di full tori…READ MORE