fbpx
April 27, 2024

One persin don kpai for Peru as protest spread against di electing of new president

0

Protest bin happun for Peru against di new government over di weekend, as one teenager don kpai for di protest base on di we no go gree, we no go gree mata.

Police officers clash with  angry demonstrators wey dey call for a national strike, fresh election and di release of former president Pedro Castillo wey bin dey for detention.

U FIT ALSO READ One persin don kpai and di other don woundjor as Tanker explode inside Ogun state

Di protest don dey ground since, bifore di South American countri legislature on Wednesday comot Castillo from post after hin try to dissolve Congress and rule by decree.

Dina Boluarte, wey bi former prosecutor wey bin serve under Castillo as vice president, immediately dem quickly sworn am in to replace Castillo.

On Saturday, she bin introduce her new cabinet, a group of pipol with an independent and technocratic profile and she carry like eight women join for her cabinet. She name former prosecutor Pedro Angulo as prime minister.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *