fbpx
April 24, 2024

One persin don kpai and di other don woundjor as Tanker explode inside Ogun state

0

One tanker don explode for Ogun State on Sunday and he don kpai one persin and woundjor onosa persin for where di incident happun

Di Federal Road Safety Corps (FRSC) tok say di crash bin occur at about 10:30 am for Sagamu/Ijebu-Ode expressway.

U FIT ALSO READ Insecurity: bandits don kill Zamfara monarch

Florence Okpe, di FRSC spokesperson for Ogun state tok say, di accident bin involve one tanker and two men.

Florence tok say“ Di Tanker wey bin explode no get registration number on am. and two pipol bin involve for di accident, and both of dem na male adults dem bi.as one of dem don kpai and di second don woundjor

According to Okpe, man wey injure dey don carry am go hospital bi one good Samaritan” bifore di FRSC operatives show face for di area.

Okpe tell tori pipol say di accident bin sele base on electrical fault wey con later result to fire outbreak,”

Meanwhile, di Ogun FRSC Sector Commander, Umar Ahmed, do sympathize with di families of di accident victims, him con still advice drivers to always check dia vehicle for safety eeason.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *