Osinbajo absence from Tinubu campaigns make pipo tag am as betrayer
Pipo dey tok say Yemi Osinbajo get strong feeling of anger and dislike for di All Progressives Congress, APC, presidential candidate, Bola Tinubu. This report come from di National President of Arewa Youths Consultative Forum, AYCF, Yerima Shettima. Osinbajo absence from Tinubu presidential campaigns so far na hin make pipo dey accuse am.
E be like say Osinbajo relationship with Tinubu during di APC presidential primaries for 2022 bin get as e be. One of Osinbanjo followers believed say di Vice President suppose support hin political godfather.
For di time wey dem do APC primaries, some strong supporters of Tinubu bin tag Osinbajo as traitor, betrayer and Judas. This na because hin stand against di former governor of Lagos State.
FOR MORE NEWS: INEC power to return candidate dey dangerous — Ex-NBA boss
One of such supporters, Tolu Babaleye yarn say: “This na di week wey Judas Iscariot betraye Jesus Christ for di Christian calendar. Same week Osinbajo betray Tinubu. Same week no be ordinary coincidence. God go dey with Tinubu for Pilate 6Court.”
As dem dey tok about Osinbajo absence from Tinubu campaigns , di AYCF President, Shettima, yarn say Tinubu no deserve that kain treatment wey hin dey receive from President Muhammadu Buhari and Osinbajo.
Shettima accuse Osinbajo say hin dey hold grudges against Tinubu since hin defeat for di APC presidential primary election.
Hin kon say, make Buhari and Osinbajo come out boldly if dem get anything against Tinubu.
Shettima yarn say di thing dey very unfortunate because things no dey go well. Hin still tok say no matter how bad Tinubu be, he don pay hin dues . Na better support hin deserve, no be this kain one wey dem dey give am.
You fit go read di full tori…READ MORE