fbpx
April 23, 2024

Over 100,000 Russian soldiers don kpai for Ukraine – US General (Mark Milley)

0

Di United States don come out tok say na over 100,000 Russian soldiers don kpai for Ukraine war wen bi start on 24 February when President Vladimir Putin give order of invasion on di neighbouring country.

America’s top General, Mark Milley yarn dis one for di Economic Club of New York on Wednesday.

U FIT ALSO READ Kenya Airline pilots don call off strike

Hin tok say casualties of di war na those pipol wen wound and those ones wen don kpai for Ukraine

Milley tok say number of causalities wen don sele na hin bi di highest US go estimate to date in di last nine-month battle.

When dey ask milley about prospects for diplomacy for Ukraine, Milley tok say just becos say dey no quickly negotiate in World War One na him make human being suffer.

Milley tell Economic Club of New York say, if opportunity to negotiate show face make dem use am in order to achieve peace.

Di army chief tok say di war don spoil many things.he don turn 15 million to 30 million Ukrainians into refugees while 40,000 civilians don kpai.

Some pipol bin yarn say di reason why russia keep calm for now na becos say he wan see maybe Ukraine go wan negotiate.

While some pipol tok say Russia fit use di negotiation to buy time and restrategize.

Di general tok say over 100,000 Russian soldiers don kpai and some dey injured.maybe na same thing to Ukrainian soldiers we no fit say.

But hin con finally end hin tok tok with “many pipol dey suffer becos of dis war so make dem try to negotiate peace”.

To read di full tori CLICKHERE

 

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *