fbpx
May 6, 2024

LG election: Oyo APC don announce new dates for primary

oyo-apc-announce-new-dates-for-primary-election

Oyo State chapter of di All Progressives Congress, APC, don announce new dates for di primary election ahead of di forthcoming local government election for di State.

According to report, di Oyo State Independent Electoral Commission (OYSIEC) fix April next year for di local government election.

Also, di APC on Wednesday announce small adjustment for di schedule of dia primary for all chairmanship and councilorship aspirants.

Di party inside statement wey dem issue on Wednesday yarn say di primary become something wey dey necessary because of multiple expressions of interest.

 

FOR MORE NEWS: Delta Approve 3 Working Days For Civil Servants

 

Publicity Secretary of di party, Olawale Sadare, inside statement bin tok say di primary wey dem bin schedule for dis Thursday go hold on Friday (August 25) and Monday (August 28).

Hin tok say dem don split di schedule of di party primary into two and dem pick dis Friday to conduct di exercise for all di Wards and LGAs for both Oyo Central and Oyo North Senatorial districts, while di turn of di 99 Wards and nine local government councils for Oyo South go be Monday next week.

In addition, hin tok say reports wey screening committees submit, show say dem get competent aspirants for all di 351 Wards and 33 LGAs; and dis one show say APC remains di most popular partyfor di State.

You fit go read di tori see why di Oyo APC announce new dates…READ MORE