fbpx
May 6, 2024

NNPP announce suspension of two members

nnpp-suspension-of-members

Di National Working Committee, NWC, of di New Nigeria Peoples Party, NNPP, don announce di suspension of two of dia members.

And, di two suspended members na one of di founders of di party, Dr Boniface Aniebonam and di National Publicity Secretary, Dr Agbo Major.

Di party yarn say dem suspend di duo of Aniebonam and Major pending di determination of investigations by disciplinary committee.

Acting National Chairman of the party, Mallam Abba Kawu Alli make dis declaration on Thursday.

For inside statement, Alli yarn say di duo of Aniebonam and Agbo dey suspended for claim of anti-party activities.

Also, hin add say NNPP go stand up to di pipo wey like to bring disgrace to di party.

 

FOR MORE NEWS: FG go unveil humanitarian fund for poverty alleviation – Edu

 

However, di man yarn say unfortunately, Dr Boniface Aniebonam, one of the founders of dia party do wetin hin no suppose do.

Also, hin yarn say dis na situation wey responsible National Working Committee,no go permit to continue.

So, in line with dia constitution, dem suspend Dr Boniface Okechukwu Aniebonam and di National Publicity Secretary, Dr. Agbo Major pending di determination of investigations by di disciplinary committee at di national level of di party.

You fit go read di tori of di NNPP announcement of di suspension of dia members…..READ MORE