fbpx
December 22, 2024

Oyo govt begins di payment of 13th month salary to all hin civil servants

Makinde-e1650830629293

Oyo State Government don come out tok say dey don commence di payment of 13th month salaries to all worker inside di state.

Dr Wasiu Olatubosun, wey bi di state Commissioner for Information, Culture and Tourism, na hin yarn dis one on Friday for Ibadan.
Olatubosun tok say di workers don start to dey receive alerts for di payment.

U FIT ALSO READ Ilesa Water Project: Consultant wey dem suspend dey accuse Osun Assembly of bribery

According to him, hin tok say Gov. Seyi Makinde-led administration on Wednesday don promise to make di workers smile, by paying 13th month salaries bifore January 2023.

Di commissioner tok say di Makinde’s administration, on May 2019, pay all workers salaries, despite say di economy of di countri is nothing to write about.

Hin tok say di current administration no go ever toy with di welfare of di state civil servants.

Olatubosun tok say di Oyo state government na one of di few state governments wey don continue to pay di minimum wage without failure.

Olatubosun tok say Seyi Makinde don stay committed to uninterrupted payment of salaries and 13th month salaries since hin become Governor.”

To read di full tori CLICKHERE