fbpx
April 27, 2024

Naija pipo get diffrent talk as allegations of paternity fraud scatter many families

paternity-fraud-olanrewaju-dna-result

Olanrewaju Kolawole, wey be indigene of Ikire for Irewole Local Government Area for Osun State, believe say him be papa to all four pikins for im house, But hope chop blow when DNA result show say di 44-year-old man no be biological papa to di four children. Di DNA test waka happen for DDC DNA Diagnostic Center for Osogbo, wey be capital of Osun State.

Kolawole run cry go radio, “Kokoro Alate” for Agidigbo 88.7 FM Ibadan, dey seek help from Nigerians. E talk say im marry Toyin Tella for 2007, and di marriage born four children. Kolawole talk say e find out say di first pikin no be im own after DNA test, and e come test di oda three, all of dem show say no be im get dem.

 

FOR MORE NEWS: ‘Japa Syndrome’ na result of leadership failure – Gov Zulum

 

Kolawole talk say, “I want Nigerians make dem helep me because I no go fit suffer dis one for nothing.”

But Toyin Tella no gree di result. She talk say she no dey there when dem carry sample, she no know which sample dem carry.

Dis tori be true life palava, no be film. Paternity fraud don scatter many family for Naija and e don make headline before, like di case wey happun between Mr. Tunde Thomas and di family of Mr. Adam Nuru for 2021. Dem talk say Moyo Thomas, wey be wife to Tunde Thomas, dey knack FCMB Managing Director, Adam Nuru, sotey she born two children wey dem believe say na for Mr. Tunde Thomas.

You fit go read di tori of di matter with Olanrewaju DNA result…READ MORE