fbpx
April 27, 2024

Former US First Lady, Rosalynn Carter don kpeme at di age of 96

rosalynn-carter-don-die

Rosalynn Carter, di wife of former President of United States, Jimmy Carter don die. She kpeme for di age of 96.

Di news of her death bin dey officially announce by di couple non-profit organization, di Carter Center, for one statement wey dem release on Sunday by 2:10 pm.

Rosalynn Carter, wey dem sabi as one person wey dey always ginger mental health, caregiving, and women’s rights, kpeme for her house for Plains, Georgia, with her family around her.

‘Former First Lady Rosalynn Carter, wey dey very passionate about mental health, caregiving, and women’s rights, kpeme on Sunday, Nov. 19, by 2:10 p.m for her house for Plains, Georgia, she kpeme gently with family around her,’ na so di Carter Center talk am.

 

FOR MORE NEWS: “Life never tire me o; I no fit use my death promote my album” – Portable shades Oladip

 

Also, she bin serve as First Lady of di United States from 1977 to 1981, during her husband Jimmy Carter presidency. In addition, she bin get reputation as one wey dey use her influence to champion important causes.  Also, she go surely be remembered for her impactful contributions to society.

Her advocacy for mental health and women’s rights go down history lane as one of di defining aspects of her legacy. She go down as one of di influential First Ladies wey use her platform to make positive changes for di people.

Also, as Rosalynn Carter don die, make we remember her, and make we reflect on her life and her commitment to making di world a better place.

You fit go read di tori for here…READ MORE