fbpx
May 5, 2024

Presidential Election Tribunal: PDP Forum dey confident of victory

presidential-election-tribunal-pdp-forum-dey-confident-of-victory

Di Forum of di Peoples Democratic Party, PDP, House of Representatives candidates for di just concluded 2023 general election don express confidence say di party go come out victorious for di Presidential Elections Tribunal.

Dem encourage members of di party nationwide to remain calm as dem await di judgement of di Presidential Election Petition Court, PEPC.

Also, na di Chairman of di Forum, Engr Ahmed Rufa’i Dagumawa make di call as hin dey address news conference for di NUJ Press Centre, Kano State, on Tuesday.

Di Forum yarn say dem dey expect very positive and good verdict wey go enhance di dignity of di judicial system of di kontri.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don send second batch of ministerial list to Senate

 

Also, as PDP express confidence, di group tok say dem get high hopes say di court go do di needful for di verdict as di judiciary na di last hope of di common man.

On di claim of division among members of di PDP for di State, di Forum tok say dem no dey aware of any faction within di ranks of the party.

In addition, di group sef yarn say as far as dem dey concerned, di PDP remain an indivisible party for di State with di members united for di good of di party and di people of di State.

You fit go read di tori…READ MORE