fbpx
May 5, 2024

Tinubu don send second batch of ministerial list to Senate

kaduna-state-ministerial-slot

Some tori dey tok say President Bola Tinubu go give additional Ministerial slot to Kaduna state as part of political calculation to make further in- road for North as well as to compensate di North West zone in particular because dem vote for am for di 2023 General election.

Dis tori come from according credible source from Aso Rock Presidential Villa as dem dey tok with newsmen for Kaduna on Tuesday.

Also, di source wey no want make hin name dey mentioned, yarn say di former Governorship candidate of di defunct Action Congress of Nigeria (ACN), Honourable Sani Sha’aban na hin dem consider for di second Ministerial slot for Kaduna State.

 

FOR MORE NEWS: Just in: Worker don start nationwide protest – Ajaero

 

Sha’aban, a former member of di House of Representatives and a close ally of President Bola Tinubu, bin dey with di ACN Governorship Candidate for Kaduna State during di 2011 Governorship election, wey di PDP candidate, Ibrahim Yakowa win.

Although di Aso Rock source yarn say di President no know who to pick between di second minister from either Kaduna or Kano State, but hin revel say di odds dey in favour of Sha’aban due to hin close relationship with President Tinubu and also as a foundation member of di ACN, wey dey founded by Tinubu when hin be Governor of Lagos.

You fit go read di tori of Kaduna state Ministerial slot…READ MORE