fbpx
May 18, 2024

Nigerians dey celebrate Eid-el-Kabir in frustration – PDP lament over cost of living

pdp-lament-over-cost-of-living

Di Peoples Democratic Party, PDP, dey lament over di increase in di cost of living, essential goods and services for di Kontri, especially as Nigerians mark di 2023 Eid-el-Kabir.

Inside statement wey dey issued on Tuesday by di party National Publicity Secretary, Debo Ologunagba, di party tok say di current economic crisis na because of di policies of di ruling All Progressives Congress, APC.

Also, di party express worries over di collapse of di purchasing power of Nigerians because of di hike in prices of commodities. Dem yarn say APC don continue to “impose life discounting policies” on citizens of di Kontri.

 

FOR MORE NEWS: Onasanya Donate Block Of Classrooms To Lagos Community

 

Part of di statement yarn say e dey sad say on an occasion like dis, millions of Nigerians dey observe di period in frustration as dem no fit afford di basic necessities to celebrate with dia loved ones.

Plenty pipo no fit express dia affection by traveling to visit or even sharing with their family members and friends all because of hardship and insensitive policies wey APC government don impose.

Di opposition party, however, advise Nigerians make dem no feel bad but use di season of Eid-el-Kabir to unite in love, support and care for one another.

You fit go read di tori see as PDP dey lament over cost of living…READ MORE