fbpx
May 18, 2024

Bayelsa Guber: Poll Predict Gov Diri Victory

poll-predict-diri-as-winner

Ahead of di November 11, 2023 governorship election for Bayelsa State, an independent poll don predict di incumbent Governor Duoye Diri as di likely winner of di election

Di survey wey dey conducted by CellHub, a data mining and analysis group, alongside a consortium of data analysts and a team of development experts between May and June 2023, show say di majority of eligible voters for Bayelsa State dey in support of renewed tenure for Diri.

Also, di poll wey dem do through informal engagement of twenty eligible voters across all of di 105 wards of di state, show a larger percentage of respondents, forty-eight percent (48%) wey support di reelection of Governor Diri, for a second term bid.

 

FOR MORE NEWS: Use subsidy savings reduce suffering, World Bank tell FG

 

According to di figures wey dem get from di survey, respondents, total about thirty-four percent (34%) wey no decide on dia choice of candidate, while eighteen percent (18%) support di candidate of di All Progressives Congress (APC), Chief Timipre Sylva, a former governor of di state.

 

CellHub data mining officer, John Paul yarn say Governor Diri proactive and frontal management of di COVID-19 pandemic, giant strides for di infrastructural sector, calmness, maturity, as well as hin easy-going nature na part of di qualities wey pipo see decide to support am.

You fit go read di tori…READ MORE