fbpx
May 18, 2024

Japa: I support Nigerian wey dey fly go abroad for greener pastures — Peter Obi

peter-obi-don-support-japa

Labour Party Presidential candidate for February 25 presidential poll, Mr Peter Obi don support Nigerians wey dey fly comot for di Kontri for greener pastures abroad, “JAPA”.  Also, hin yarn say di move go benefit Nigeria fortune for future.

Di former Anambra governor wey gain massive support from Nigerians, especially on top Social media for di just concluded electioneering campaign because hin be “prudent and incorrupt politician”, tok say di brain drain today go be Nigeria brain gain tomorrow.

Ex-governor Obi, inside series of tweets, on Thursday, support Bill Gate opinion on di migration wave wey don hit Nigeria.  So, Inside di tweet, hin yarn say as “Nigerians dey leave di kontri, na wetin go dey critical in di building of di New Nigeria.

 

FOR MORE  NEWS: Bauchi gov don reappoint Mukhtar Gidado as media aide

 

Hin yarn say hin don read and agree with Bill Gates recent comment on di ‘japa syndrome, where, according to reports, hin tok say di recent surge of Nigerian professionals wey dey leave di kontri for greener pastures dey good and healthy for our country.”

Obi tok say hin don always preach and maintain dis same position say ‘Our brain drain today will be our brain gain tomorrow’.”

Also, hin yarn say as Nigerians dey leave di kontri, e fit look like loss today, but when we start to do di right things and take di governance of our nation more seriously, di knowledge and resources from dem go dey critical in di building of di New Nigeria, just as e happen for China, India, Ireland and other developing countries.

You fit go read di tori as Peter Obi don support JAPA…READ MORE