fbpx
May 18, 2024

Bauchi gov don reappoint Mukhtar Gidado as media aide

bauchi-governor-reappoint-gidado

Bauchi State Governor, Senator Bala Abdulkadir Mohammed, don reappoint Mukhtar Mohammed Gidado as hin Special Adviser on Media and Publicity.

Di tori of Gidado reappointment come out inside letter signed by Danjuma Garba, Permanent Secretary, General Services Department, on behalf of di Secretary to di State Government (SSG), wey direct di governor media aide to continue to function with dat capacity.

According to di letter, Gidadi dey exempted from di disengagement order wey dem issue on 25th May 2023 to all political appointees, and e dey based on hin track records, hard work, trustworthiness, dedication, commitment and wealth of experience.

 

FOR MORE NEWS: FG don approve re-opening of Seme border for vehicle importation

 

Also, Inside di letter, dem inform His Excellency, Sen. Bala Abdulkadir Mohammed, CON, (Kauran Bauchi), di Executive Governor of Bauchi State, say hin exemption from the disengagement order dey approved.

Accordingly, hin go need to remain and continue to serving as di special adviser, media and publicity. Dis na wetin part of di letter tok.

Also, inside di letter, dem advise di governor media aide make hin bring di attributes wey set am aside to bear while discharging hin duty.

In addition, dem expect am make hin continue to bring these good qualities wey hin get to discharge hin responsibility and justify di confidence wey dem don give am.

You fit go read di tori as Bauchi Governor reappoint Gidado…READ MORE