fbpx
December 23, 2024

“Petrol fit enter N800/litre if FG comot subsidy” – Oil Marketers

petrol-fit-enter-n800-litre-if-goverment-comot-subsidy

As di scarcity of petrol continue on Sunday, oil marketers yarn say petrol fit enter N800/litre once subsidy on PMS don comot.

Industry operators don repeat am say di high cost of subsidy on petrol na burden on di Nigerian National Petroleum Company Limited and e contribute to di prolonged crisis for di downstream oil sector. NNPC na di sole importer of petrol into Nigeria.

Di Minister of Finance, Budget and National Planning, Zainab Ahmed, bin suggest say make government gradually withdraw subsidy on PMS. She yarn say di budgetary allocation for subsidy go end in June.

But oil marketers yarn say even as e dey advisable to remove subsidy, Nigerians need to know say di cost of petrol fit cross N800/litre once di commodity no dey subsidised.

FOR MORE NEWS: Banks dey battle shortage of new naira notes

Di oil marketers advise di Federal Government make dem ensure say all di necessary measures and infrastructure dey available so that di  subsidy removal go dey less stressful. Dem follow yarn say make di regime dey in place before dem implement di decision.

If government fail to do wetin dem suppose do, and dem yarn say dem wan remove fuel subsidy, di situation go worse pass as e dey now, plenty pipo go suffer.

Di Secretary, Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, Abuja-Suleja, Mohammed Shuaibu, yarn say how dem wan remove subsidy when dem no get di product (petrol).

Hin add say If government  wan remove subsidy, maybe by that time, petrol go be N800/litre, if not more than that.

You fit go read di full tori…READ MORE