fbpx
May 19, 2024

Ogun State Government don announce work-free days for PVC collection.

ogun-state-government-announce-work-free-days-for-pvc-collection-

Ogun State Government don announce work-free days for PVC collection. Dem don don take step to make sure say workers participate fully for di forthcoming general elections. Governor Dapo Abiodun’s government announce Tuesday, January 24th, and Wednesday, January 25th, as work-free days for workers for di state public service so that dem go fit go to collect dia permanent voter cards (PVCs).

Na for inside statement signed by di chief press secretary to di Governor, Kunle Somorin, na hin di declaration dey.

FOR MORE NEWS: “Petrol fit enter N800/litre if FG comot subsidy” – Oil Marketers

He yarn say following di extension of Permanent Voter Cards collection till Sunday, January 29, 2023, by di Independent National Electoral Commission (INEC), Governor Dapo Abiodun don approve two days — Tuesday, 24th and Wednesday, 25th January — as work-free days to enable public servants collect dia  PVCs from dia respective local government.

Ogun State Government don announce work-free days for PVC collection. Dem yarn say to vote na civic responsibility.  Hin add say all eligible citizens must exercise dia rights to choose who go  govern them.

You fit go read di full tori…READ MORE