fbpx
May 18, 2024

Benue Police don confam di arrest of woman wey beat her 10-year-old stepson to death over piece of meat

benue-police-don-confam-di-arrest-of-woman-wey-beat-her-10-year-old-stepson-to-death-o

Di Benue State Police Command don confam di arrest of one woman, wey be mama of two, Mrs. Charity Upev for allegedly beating her 10-year-old stepson, Fanen, to death over a missing piece of meat.

This incident happen on Monday, January 23, 2023, along di popular Abu King Shuluwa Way near di international market, behind Deeper life camp for Makurdi, di state capital.

E dey gathered say Police arrest di suspect after her neighbours report di issue to di ‘E Division’ of di State Police Command.

One source for di neighbourhood wey no want make dem reveal hin identity, open up about di death of di deceased. Infact ehn, this matter almost cause protest from angry youths for di area.  However, as Police quickly intervene, arrest di woman, e make di situation calm small.

FOR MORE NEWS: “All your achievement for life na to dey kiss different ladies on set” – Mike Bamiloye don call out Nollywood actors

According to di source, dem yarn say di woman beat di boy on Sunday morning because of meat wey hin pick from pot soup. But much later in di evening, di boy kon start to dey vomit wetin dem suspect to be blood.”

As a result, dem rush di boy go hospital. E neva too tey wey doctors announce say di boy don kpai.  So everybody dey tok say di boy wey be di stepson of di woman fit don suffer internal bleeding wey lead to hin death, police don arrest her now.

 

 

Though,na assumption because di autopsy on di cause of death neva com out. But di general belief for di neighbourhood be say hin die as a result of di beating wey hin receive earlier that day.

Di spokesperson of di command, SP, Catherine Anene, wey confam di death of di 10 year old boy yarn say dem don arrest di suspect.

 

As di matter be now, di PPRO yarn say di remains of di boy dey deposited for inside morgue of Bishop Murray hospital Makurdi. Dem dey wait for di autopsy result, and investigation of di matter still dey go on.

You fit go read di full tori…READ MORE