fbpx
May 18, 2024

“All your achievement for life na to dey kiss different ladies on set” – Mike Bamiloye don call out Nollywood actors

mike-bamiloye-dey-call-out-to-nollywood-actors

Di founder of Mount Zion Ministries, Evangelist Mike Bamiloye, don give warning to Nollywood actors and filmmakers wey enjoy to dey kiss and romance opposite sex when dem dey on movie sets.

This update dey come after Mike Bamiloye warn pipo from broken marriage say make dem no dey advis di single ladies. He tell dem say make dem stop to dey teach young ladies how to disrespect di marriage institution.

Now, Mike Bamiloye dey call out to Nollywood actors for Instagram. This na especially because of di nudity wey dey trend for di Shanty Town movie.

Mike Bamiloye write to Movie-Maker, hin ask dem weda dem think say dem dey produce better movie, dem dey make money and dem dey popular.

FOR MORE NEWS: “After you don scatter my ….” – Mercy Eke Tell Actor Chidi Mokeme For Inside Goofy Video

Hin tell di Nollywood actors say how dia wives for house fit dey alright when dem dey watch dia husband as hin dey passionate kiss another lady inside Movie!

On top that one, hin ask say wetin go become of dia Children later as dem don see dia papa dey kiss and romancing other women for movies.

Hin yarn say, how marriages no go scatter with all these thing.

Under those circumstances, hin yarn say plenty actors don kiss and romance cemetery Ghosts wey dey cover dia sef as Movie Actresses!

And because of these things, Lustful and Sexual spirits don possessed some men for di Movie Sets and dem no fit ever get settled home again!
Unless God intervene!

You fit go read di full tori…READ MORE