fbpx
April 24, 2024

Police wey flog person with Machete dismiss

0

This story wey I see inside the nation online sweet my belle reach my brokus, as the Oga patapata of police Inspector-General of Police (IGP) Usman Baba on Monday don pursue Police Constable (PC) Liyomo Okoi with force number: 524503.

Okoi, wey dey attached with Ekori Divisional Headquarters, Cross Rivers Police Command, don chop breakfast, as IG don pursue him for gross misconduct wey dey  inside a viral video on posted on July 31, 2022, where him be dey flog one man with machete.

His dismissal, according to a statement by the Force Public Relations Officer, CSP Olumuyiwa Adejobi, go start yesterday wey be Monday.

The IGP yarn say them no go relent for ethical regeneration, restoration of professional standard and enhancement of the anti-corruption drive with dedication to entrenching human rights-driven policing within the country.

He add join am say, all the bad bad police wey dey spoil the names of Nigeria police force go dey collect one by one. The full talk talk dey inside thenation online, enjoy the full tori here READ MORE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *