fbpx
April 26, 2024

Politicians dey buy PVCs from voters, INEC don raise alarm

0
INEC

Di Independent National Electoral Commission, INEC, don raise alarm say some politicians dey buy Permanent Voter Cards, PVCs, and dem dey use money dey bribe unsuspecting voters so that dem go get their Voter Identification Numbers.

Di Acting Chairman of INEC and National Commissioner wey dey oversee di FCT, Nasarawa, Kaduna and Plateau states, Mohammed Haruna, raise di alarm on Monday during di launch of #YourVoteMatters project by election observer group, NESSACTION, for Abuja. Na for there hin reveal say two pipo recently dey convicted for illegal possession of PVCs for Sokoto and Kano states.

YOU GO LIKE READ: How to Educate Yourself on a New Subject

Di project wey dey supported by di International Foundation for Electoral System, IFES; di United States Agency for International Development, USAID; and di Foreign, Commonwealth and Development Office, FCDO, wan help INEC increase di number of PVCs wey dem don collect ahead of di 2023 general elections as well as di voters wey go move on election day.

Di INEC National Commissioner warn di electorates make dem no compromising di ownership of their PVCs;

Na wetin hin talk be this; “We are aware some politicians are more or less buying the PVCs. If you collect the PVC and then you sell it out or allow someone else to have it, you are aiding illegal possession of the PVC which is an offence in our Electoral Act.

This tori dey inside Vanguard…READ MORE

For more news: Nigeria elections: We no get candidate wey we like, political party – US

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *