fbpx
May 18, 2024

“I be responsible man, I dey take care of 20 women but make money before love” ― Portable

portable-be-responsible-person

Di controversial singer Portable from Nigeria don admit say unlike wetin some pipo fit dey think, hin love women and hin be responsible person.

As ladies only love men wey something gum dia body, Portable boast say hin dey take care of 20 women while other men dey find am hard to support one.

Also, hin claim say hin be hustler and loving man wey dey put money before love.

Dis na wetin hin tok for inside video message wey hin post on top hin social media account.

 

FOR MORE NEWS: “Bad Belle” – Reactions as Lata Tondon comot her congratulatory message to Hilda Baci

 

Di papa of five yarn say “Some men no fit take care of one woman, talk less of 20 women. (sic)

“I’m a responsible man. Fear who doesn’t fear women. I love women. I take care of women. I’m a hustler. I’m a lover man.

“Make money before love. If you have money women will chase after you. If you don’t have money you will never be perfect. Your caring would be like disturbance.”

“Try to be yourself. Hustle for yourself. I’m responsible for myself because of my future,” Na wetin Portable tok be dat.

You fit go read di tori see wetin Portable tok as hin say hin be responsible person….READ MORE