fbpx
May 5, 2024

Post-election crisis dey shake Abia APC

post-election-crisis-for-abia-apc

Di Post-elction crisis for Abia State chapter of di All Progressives Congress, APC don dey tun to water wey pass garri.

Dis latest matter of di Post-elction crisis for Abia  APC dey come just two weeks after di conclusion of di 2023 general elections.

Also, inside di latest crisis, di two factions of di party announce di suspension of some stalwarts.

Inside long press release wey dey signed by Chief Ofor Okorie, State publicity secretary, di APC faction accuse Emenike and Ononogbu of anti-party activities among other alleged offences.

However, on Wednesday, di faction wey dey recognised by di national secretariat also suspend Ogah, Senator Nkechi Nwogu, Sam Onuigbo and some other top members.

In addition, di statement wey suspend Ogah and others dey signed by Ononogbu and Chidi Avajah, Chairman and secretary respectively.

FOR MORE NEWS: Presidential election: I advise Atiku, Tinubu make dem step down for younger generation – Wole Soyinka

Also, di letter accuse di suspended members of involving in anti-party activities among other allegations.

But reacting to her suspension, Nwogu describe am as “total nonsense and she yarn say e no fit stand.”

Rather,  she claim say di money wey dem to di party for di logistics during di polls bin dey hijacked by top shot of di party.

Also, apart from di suspension and counter-suspension, some candidates of di party from di two factions still dey for court over pre-election matters.

APC win one Senate seat, one House of Reps seat and one House of Assembly seat for di last general elections for Abia.

You fit go read di tori…READ MORE