fbpx
December 22, 2024

Presidential poll fail to meet Nigerians’ expectations -US envoy

presidential-poll-fail-to-meet-nigerians-expectations

Di United States Ambassador to Nigeria, Mary Beth Leonard, don yarn say di Presidential poll fail Nigerians’ expectations for di February 25 elections.

Even as di Presidential poll fail Nigerians’ expectations, di ambassador acknowledge say plenty Nigerian dey vex and dem dey frustrated with di results, while some others dey celebrate victories wey dem believe say  na hard-fought and well-earned.

However, she commend Nigerians for demonstrating dia dedication to democracy.

Leonard, advise di Independent National Electoral Commission make dem promptly address di challenges wey fit dey resolved ahead of di March 11 gubernatorial elections. ALSO, make dem undertake a broader review of di problems wey happen during di last elections and see wetin dem fit do to fix them.

FOR MORE NEWS: “Na di pattern be dis”- Netizens don react to claim of JJC Skillz wey move go hin new wife house for Abuja

In addition, she advise INEC make dem share with di Nigerian public information about di actions wey dem dey take.

She tok all dis one for op-ed, ‘The Elections of February 25.’

She commend Peter Obi and Atiku Abubakar for dia commitment to take the legal path to contest di presidential elections and also di  president-elect, Bola Tinubu, for acknowledging dia right to do so.

You fit go read di full tori…READ MORE