fbpx
April 29, 2024

“Na di pattern be dis”- Netizens don react to claim of JJC Skillz wey move go hin new wife house for Abuja

jjc-skillz-new-wife-house-abuja

Netizens don react to claim report of former Nigerian singer and filmmaker, Abdulrasheed Bello better known as JJC Skillz wey move go hin new wife house.

Instagram blogger, Cutie Julls claim say di ex-husband of Funke Akindele, JJC Skillz don move into hin new wife house for Abuja.

According to di blog, dis no be di first time wey di former rapper go dey move into hin women house.

JJC Skillz bin dey live with one of hin baby mama’s house, Benito mama. Dis na before hin leave her go marry actress, Funke Akindele. Dat time hin bin stay for Funke house before dia separation in 2022.

Also, reacting to di matter, plenty social media users describe JJC Skillz as playboy and dem tok how e don become hin pattern to move into hin women house to exploit.

FOR MORE NEWS: “I no know say I go see di day all Nigerians go focus on politics” – Falz

See Netizens reaction below;

One Duchess of Festa write, “I think this guy is looking for rich women to exploit

One Lovable Uzor write, “Omo e no go better for his village people o

One Puchis grace write, “At dis point hin suppose buy house no matter how small, I sure say hin fit afford am. Different house plans, dey no matter how small, better than moving into every ladies house.

One Frau Favour write, “People dey marry dia wife dey move into dia house, him own dey different

One Esther Luve write, “Dis na hin pattern and hin suppose find help spiritually to break it am

One Blonde beautyng spa write, “Playboy lifestyle….. always looking for made women or rich men daughters

One Krystabel write, “Why hin dey always be di one to move into dia houses

You fit go ee di full gist…READ MORE