fbpx
December 22, 2024

Priscilla Ojo don explain rumours about her relationship with Enioluwa

priscilla-ojo-relationship-with-influencer-Eniola

Priscilla Ojo, di actress Iyabo Ojo daughter, don explain di truth around her relationship with influencer Enioluwa.

Remember say di two bin spark dating rumors when Enioluwa go public with dia relationship a month back.

But di two insist say na only friends dem, be, and plenty  pipo no gree believe di tori, especially because of dia frequent displays of affection in public.

Priscilla upload screenshot of her friendly Snapchat chat with Enioluwa to correct di record.

Enioluwa bin celebrate hin friendship with Priscilla for di talk and hin tok say hin dey blessed.

 

FOR MORE NEWS: “It must have cost a fortune” -Chioma Akpotha surprise plenty pipo with her home makeover

 

Also, di influencer pray say make dia friendship dey blessed and make dem always be friends.

To join di screenshot, de write message wey slam pipo wey think say opposite sex no fit be friends without any attachments.

“Seen a lot of posts saying we aren’t friends bla bla bla and we are dating ish but we are using friendship methods to cover up, how???

A lot of y’all don’t have genuine male friends and it shows. Everything isn’t about sex grow up!

@lipglossbaby it’s a forever thing over here”.

You fit go read di tori about Priscilla Ojo relationship with influencer Enioluwa…READ MORE