fbpx
April 26, 2024

2023 elections: Protesters call for interim government, arrest of INEC chairman

protesters-call-for-inec-arrest

Protesters under the protection of Free Nigeria Movement on Tuesday call on President Muhammadu Buhari say make hin cancel di February 25 presidential election and set up an interim government pending di conduct of fresh election, also, di group call for di immediate arrest and prosecution of Prof Mahmood Yakubu, chairman of di Independent National Electoral Commission, INEC, for claims wey tok say hin supervise wetin dem describe as a fraudulent presidential election.

All of dem make di demand during di protest to di INEC headquarters for Abuja.

Convener of di FNM, Moses Ogidi-Paul, wey tok on behalf of di group, express dia mind say dem no happy with di conduct of di February 25 presidential election.

According to hin speech: “On the 25th of February, 2023, Nigerians troop out to dia polling units with one mission, to cast dia ballots and choose dia next leaders.

You fit go read di full speech on why protesters call for interim government and INEC chairman arrest …FULL SPEECH

According to hin speech, hin yarn say di Kontri need healing. And hin tok say e no go good if dem allow fraudulent process continue because fraud go eternally born fraud. Also, hin tok say we no fit grow our democracy on falsehood and suspicion.

Hin yarn say dem need to immediately establish a Truth and Reconciliation Committee for Lagos State and other flashpoints of voter intimidation and violence during di presidential, National Assembly, governorship and State Assembly elections. According to di man, na dat one go help build trust, confidence and further ethnic cooperation among Nigerians.

FOR MORE NEWS: INEC declare Adamawa gubernatorial poll inconclusive