fbpx
December 22, 2024

R. Kelly go serve 30-year jail term for North Carolina prison

r-kelly-go-serve-30-year-jail-term

RnB singer, Robert Sylvester Kelly, wey dey known as R Kelly, don go correctional centre wey dey for North Carolina, di United States of America, where hin go serve hin 30-year prison sentence in connection with plenty sexual offences.

Di US Federal Bureau of Prisons announce say dem move am go di Federal Correctional Institution for Butner, North Caroline Wednesday last week from di Metropolitan Correctional Center for Chicago.

R Kelly, in February 2023, bin dey sentenced to one additional year in prison for hin Chicago conviction of federal child pornography and child enticement charges.

Dat one dey in addition to di 30 years wey hin dey serve already for separate conviction out of New York.

 

FOR MORE NEWS: United lead Chelsea dey in race for Osimhen

 

Also, in September, a federal jury for Chicago bin convict di singer of six-count charges of sexual abuse against three women.

And, di women follow testify under di pseudonyms names Jane, Pauline, and Nia on video.

In addition di jury of enticement charges involving two other accusers bin forgive am dat time – Tracy and Brittany.

Also, dem bin forgive di singer for seven other charges, including obstruction of justice.

You fit go read di tori of R Kelly 30-year prison sentence…READ MORE