fbpx
May 18, 2024

United lead Chelsea dey in race for Osimhen

chelsea-dey-in-race-for-osimhen

Manchester United according to report, dem dey ahead of Chelsea in race for di Napoli forward Victor Osimhen during dis summer transfer window.

Di Nigeria international don dey on impressive form for hin Italian side during di 2022-23 campaign. Dis na as hin score 26 goals and registering five assists in 32 appearances for  all competitions.

Osimhen don net 21 Serie A goals dis term, with hin form a key contributor to di Naples giants wey dey for 17 points clear of second-placed Lazio for di top of di table.

Di 24-year-old bin no fit help hin side reach di semi-finals of di Champions League, though, with AC Milan running out 2-1 winners for di two-legged quarter-final affair.

Osimhen still get another two years left to run hin current deal, but plenty speculation surround hin future ahead of di summer window.

 

FOR MORE NEWS: Africa richest man, Dangote go soon buy French club

 

Man United and Chelsea dey linked with di Nigerian, while Bayern Munich and Paris Saint-Germain follow wan secure his signature.

According to Football Insider, Man United dey ahead of Chelsea for di race, with di latter wey dey expected to find am difficult to meet Napoli huge price for di summer market.

Di Blues go need to sell plenty players dis summer to keep within di Financial Fair Play restrictions due to dia huge spending over di last couple of windows.

Also, Chelsea dey almost sure to miss out on Champions League football for di 2023-24 campaign, with di club wey dey for 11th spot for di Premier League table, 20 points behind fourth-placed Manchester United, wey follow get game for hand.

Any deal for Osimhen fit cost in excess of £100m, and e no clear how much money go dey available to Man United head coach Erik ten Hag dis summer due to di ownership situation for di club.

You fit go read di tori as Chelsea dey in race for Osimhen…READ MORE