fbpx
May 18, 2024

FG don approve re-opening of Seme border for vehicle importation

FG-approve-re-opening-of-seme-border

Di Federal Government, FG of Nigeria don approve di re-opening of Seme land border for di importation of vehicles.

Na di Director of Road Transport for di Ministry of Transportation, Ibrahim Musa, na hin make dis disclosure on Wednesday.

Also, Musa, wey tok for di Economic Community of West African States, ECOWAS, meeting wey dey organised between officials of Nigeria and Benin Republic, reveal say di development follow complaints by freight forwarders wey dey operate for di Seme border.

He yarn say hin bin dey there with di former Minister of State for Transportation when di freight forwarders beg say make border dey reactivated for di free movement of goods and services.

 

FOR MORE NEWS: ‘Calm Down’ By Rema Don Make History as Most Played Song on Top US Radio

 

Di former minister make dem prepare memo to dat effect. After dem consider am, dem send am give government.

Similarly, di Customs Area Controller of Seme Border Command, Dera Nnadi, wey tok for di event, lament say di service don notice reduction for di revenue since di importation of vehicles through land borders bin dey suspended by di immediate past administration.

Also, Nnadi yarn say di former Minister of Transportation, wey dey respond to some of dia requests and from stakeholders, don promise carry dem go di Federal Executive Council, FEC, one of dem na how to fully open dis border.

You fit go read di tori as FG approve re-opening of Seme border…READ MORE