fbpx
June 17, 2024

“I join Nigerian Army because of pressure to marry” — Buhari

reason-buhari-join-nigerian-army

President Muhammadu Buhari don share di main motivation behind di reason why hin join di  Nigerian Army.

According to di President Buhari, di reason why hin join di Nigerian army where he retire as a Major General, na so that hin go escape di pressure of getting married.

Di President reveal this update during hin visit to di Emir of Daura, Faruk Faruk, after hin inaugurate two roads for Katsina state.

President Buhari yarn say hin secure hin first job early after school so that hin go manage  co-operative for Daura.  However, hin escape join di army when pipo bin dey pressure am say make hin go married.

In addition, President Buhari yarn ay hin tell Governor Aminu Masari di story of how hin comot for Daura to join di army. Hin tok say na so God planned . Pioo fit make choice for life, but eventually destiny dey before God.

FOR MORE NEWS: Nigerian Student convert hin hostel room to big retail store inside Viral video

Additionally, in tok  say hin bin dey di war front during di civil war, and hn see how  plenty pipo kpai. Hin tok say some fall down beside am, but na God keep am.

In continuation, hin tok say bridge scatter for some place just before dem reach some places, and after dem crossed. In summary, hin yarn say hin dey alive today  only by God’s grace.

You fit go read di full tori…READ MORE