fbpx
May 6, 2024

Naira redesign: Uncertainty as Supreme Court don nullify policy

redesign-policy-supreme-court

On Friday, di Supreme Court invalid di naira redesign policy wey di Central Bank of Nigeria, CBN start, with di support of President Muhammadu Buhari.

According to resort, di policy, wey come into effect early this year, throw plenty citizens inside untold suffering, and bank customers kon dey spend days for queues to struggle to access cash.

Di apex court don rule am now say dem do am with due consultation and in line with constitutional provisions.

However, di Supreme Court order say di old Naira notes go continue to be legal tender, and dem nullify di redesign policy. Di new Naira notes side by side with di old notes go dey till December 31, 2023.

Dis new update come as big relief to plenty Nigerians, especially those wey feel say e no serve di purpose during di Saturday elections.

Buhari for inside nationwide broadcast bin approve di policy in a bid to reduce vote buying, as well as strengthen di economy.

FOR  MORE NEWS: 2023: Form unity government, reach out to Atiku, Peter Obi personally – Ohanaeze tells Tinubu

However, di question wey dey on di lips of many Nigeirians be say: to which extent di policy work?

Ridwan Oke, di Managing Partner, di Iris Attorneys LP, a Lagos-based law firm, yarn say “For vote buying, hin think say e work to a large extent,”

“However, di government know say election go dey this year. Dem for started di policy long ago and block di necessary loopholes wey politicians fit get to collect money  buy votes.

“Di ordinary citizen suffer like say tomorrow no dey because of di policy, including myself,” Na wetin di man tok be dat.

Meanwhile, another fresh concern na whether President Buhari go obey di court judgement.

Okey follow chook mouth for di matter: “Hin yarn ay e  expect make di President obey di judgement but with President Buhari, things no dey always dey straightforward.

Most Nigerians dey expect announcement from either Buhari or di CBN Governor, Godwin Emefiele, to know di next steps.

But Oke insist say e dey down to Buhari.

You fit go read di full tori…READ MORE