fbpx
May 18, 2024

“No woman suppose leave her husband to become single mother” – Rita Daniels advise

rita-daniels-advise-women

Di mother of Regina Daniels, Rita Daniels don advise women make dem no ever leave their husbands due to marital issues to become a single mothers.

Rita Daniels claim some women abandon dia spouses and children so dat dem go fit become single mothers.

She make am clear say woman no suppose run comot for house, leave her partner and her children just so dat dem go become single mother and begin prostitution.

 

FOR MORE NEWS: “Davido still dey call my line upon everything wey I tok about am” – Anita Brown

 

She admit say she no support ladies wey end dia marriages, leave dia pikin with dia husbands.

She reason am say na man suppose be in charge of raising di family and say any woman wey choose to leave her husband and children behind no suppose expect anything positive from di children when dey grow older.

In di statement wey she make for di video, na wetin she tok be dis, “A woman shouldn’t leave her man and kids to become a single mother and start sl€eping around. I’m not in support of women who leave their husband’s houses just to flex around. A man is supposed to take responsibility for the family, but when you abandon your children with him, don’t expect any benefit from those children when they grow up.”

You fit go read di tori see as Rita Daniels advise women…READ MORE