fbpx
April 20, 2024

Ibijoke-Sanwo-Olu. Want plenty Training For Youths

0
Ibijoke\Sanwo\Olu.

Sanwo Olu’s Wife Want plenty Training For Youths

The Wife of Lagos State governor, Dr. Ibijoke Sanwo-Olu don tell people for private area and public spirited individuals make dem come together with government to fashion out programmes wey go help youth for the society make them develop dia sef.

For the graduation of one summer coaching programme wey bin dey organised by Wuraolami Foundation, the name na: “Impact and inspire summer programme for social correctional centre for girls in Idi-Araba, Mushin, Lagos, Dr Sanwo-Olu, talk say youths dey made up of 60 percent of the population.

She say international policies and programmes for the youth need to dey carried out so that dem go fit take care of the younger generation.

The governor wife wey bin dey represented by Mrs Comfort Adeleke wife of Reverend Bukola Adeleke the Special Adviser to Lagos State governor Babajide Sanwo-Olu on Christian Religious Affairs, talk say government must continue to do dia part. She point out say government no go fit by dia sef handle the myriads of challenge wey the society dey face.

She talk say dem need private sectors, multinational agencies, non- governmental organisations, and public spirited individuals make dem join hand continue to do the one wey dem fit do to encourage the government…READ MORE

You fit still enjoy this one:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *