fbpx
April 26, 2024

ASUU don announce endless strike ‘after fruitless talks with FG’

0
ASUU\endless\strike\

ASUU Strike update.

ASUU don announce another endless strike after dem talk with Federal Government. E be like say beta thing no comot for the talk. ’

Na for the announcement wey ASUU President, Prof Emmanuel Osodeke sign na im dem confam this tori.

He talk say NEC investigate with regret say the union don experience plenty dishonesty of very high level for the last five and half years. He say the federal government put ASUU for fruitless and endless agreement without any show of absolute loyalty.

As dem dey look wetin dey happen and the thing wey government bin talk on 14th February 2022, so far, NEC don concluded say the things wey the union want, dem neva do am.

As things dey go now, NEC don talk say dem go roll-over strike to a full, and endlessstrike and the action go start from 12.01am Monday 29th August 2022.

Dem add say: “NEC admit with appreciation the past and current effort wey some Nigerians and groups don do for wahala wey still dey ground. He say dia union go still dey open to any meeting wey make sense as dem dey do since.
ASUU don start the strike since February 14, 2022, after the Federal Government fail to do the things wey dey tell dem make dem do…READ MORE

To read more of this tori, CLICK HERE.

You fit also enjoy: ASUU talk say dem no call state versities quack.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *